Lyrics: Mr 2kay – ‘Who No Like Better Thing’

    0
    412

    (Songwriter: Mr 2Kay)
    Who born monkey wey no like banana
    Who born crayfish wey no like to bend
    You see
    For my life me I no like pretend
    Who born the fish wey no go swim water ah
    How I no go love you when your papa na governor
    Tell me
    How I no go love you when your mama be minister ey
    How I no go love you when your uncle be senator
    For story to change
    Na just one signature OhChorus
    Say if I love you
    You go feel my love oh
    My love oh
    Say if I love… you
    You go feel my love oh
    My love ohHook
    Who no like better thing make I see
    Who no like better thing make I see
    Who no like better thing make I see
    Who no like better thing make I seeverse
    Jennifer too fine
    Dem say she too get big eye
    Na only big men she dey find
    Dem say she too like money
    Na only big thing she dey buy
    Every weekend she dey for dubai
    As long as you get the money, chai
    She go love you die
    Small Chidinma comot for house
    She come back with belle
    Aunty begin dey vex say who be the boy
    She say na that boy for market
    Wey dey sell next to shop
    Aunty vex increase
    So you no see commissioner pikin
    You no see otedola pikin
    You no see Mike Adenuga son
    Or you no see lulu brigs pikin
    Dangote sef you no seeChorus
    And she say hey hey hey
    Aunty na love oh
    Na love oh
    And she say hey hey hey
    Aunty na love oh
    Na love ohHook
    Who no like better thing make I see
    Who no like better thing make I see
    Who no like better thing make I see
    Who no like better thing make I see

    © NET Newspapers 2015. All Rights Reserved. Please use sharing tools. Do not cut, copy or lift any content from this website without our consent.
    …Read More

    Source:: The NET